We No Dey Give Admission Through Text Message ~ UNILAG




Authorities for University of Lagos talk say dem no dey give admission through text message. Dem dey warm everybody, “make una no fall for yahoo-boyz because we no dey send admission through text”.

Any text meassage you receive sayin you don get admisiion for UniLag na wayo o. The school don advice say make you delete that message, no be dem send am.

This na because many candidates dey restless as dem dey look for admission so, ei dey easy for 419 to play dem because dem dey hope for admission. So remember; University of Lagos no dey send admission through text message or SMS.

If you wan donate money give 419 for free, you fit reply de message (na your cup of tea).



Comments