46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Suspect; Ifeanyi Atogu
Mr. Ifeanyi Atogu
 
The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter.



For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb, he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old.



They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’.



Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil.



Even though the man don confess. Dem still carry the case go SCID (State Criminal Investigation Department) for that Anambra, after the officers don confirm the matter again, den dem go charge am to court. That means say, even though dey arrest am and he confess, dey never charge am officially so anything can happen. If he get money he fit still find way go free, this na Naija after-all.


Tufiakwa!

Comments