Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Military kill 5 suspected militants as Avengers use style dey beg government



Yeye Everywhere!


For the website of Niger Delta Avenegers, dem post one kan yeye message wen no get head or tale title: "NDA IS READY WHEN NIGERIA GOVERNMENT IS READY". Waitn that mean be say, dem dey use style take beg government say they no want war, make dem talk how everybody go get waitn dey need (justic).


Nahim Nigerian Military kon release another yeye report say, while dem dey train for Rivers State for one operation 'Crocodile Smile', say dey kill 5 militants and catch 23 other suspect. But the picture wai dey release no con make sense at all. Em be like say dey nab university cultist con dey claim say na militants.





See the mumu weapons military say militants dey carry. May be na psychlogical warfare plus government properganda.





This na how real militant weapon look like:








Nigeria military and Niger Delta Avengers, una try. Make una stop all the forming sitdown settle.


Comments

  1. we're waiting and watching

    ReplyDelete
  2. We're waiting and watching

    ReplyDelete
  3. Extremely pleasant article, I appreciated perusing your post, exceptionally decent share, I need to twit this to my adherents. Much appreciated!.  check this out

    ReplyDelete

Post a Comment

Na aproko mata be this so make una no over reason am. I wan make una know say; I no fit agree with everytin way people go comment, but that no mean say I no go post am.

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Buhari Dey Warn NDA: 'Come Talk Or Else!'

‎President Mohammadu Buhari don send warning give the Niger Delta Avengers say make dem talk now or him go show them pepper! He say if dey no agree to talk, he go treat dir 4ke up de way he dey do Boko Haram. In case you no know; The Niger Delta Avengers na militant group way dey show say dey go school. Since dem dey blow up pipelines in protest, dey never kill anybody, they just dey post real words for correct English about waiten dey pain dem. Unlike Boko Haram wai no know why dem dey kill people. But Buhari talk say dey go get the medicine of Boko Haram if dem no stop and come talk with government. Ei dey clear say Buhari never find oil for North as he dey search before. So now ei don put eye again for the Niger Delta oil because na from dir 80% of the country money dey come (even as the very small community wai get this oil dey live in poverty).‎ Dos small community no get light while the oil for thier land dey power big big cities and even Ghana. Even if we ove...