Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.

 

The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem. 

 

Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.


 

Comments

  1. You see as dem no wear the woman handcuff but as soon as their own oga commot, dem put handcuff for am. Men dem dey see things joor.

    ReplyDelete
    Replies
    1. I no see the video, I want to download the video (especially the part were he shoot himself for head).

      Delete
    2. Normal na... They must handcuff him because na the wife call police (no be other guest call police but the woman na call police). Dem no arrest am but him for don shame say him boys dey retrain am.

      Delete
    3. He commit the act hours later wen the matter don settle. No footage of him harming himself.

      Delete

Post a Comment

Na aproko mata be this so make una no over reason am. I wan make una know say; I no fit agree with everytin way people go comment, but that no mean say I no go post am.