Skip to main content

Posts

Showing posts from March, 2019

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Kourtney Kardashian remove cloth for Instagram b’cos of her Poosh

With over 74 million Instgrama profiles following her, the 40 years old Kourtney Kardashianer commot all her dress snap picture post for her Insagram profile. All this she do for publicity for her upcoming brand called Poosh which don already get over 2 million followers before the lunching. Dat means say before pipu even know waytn the label be about, dey don ready to follow am so dey go know dem as the one wey sabi new trend. In case you no know, she be mother (MILF) but look like cici wen never born. Her move don already start to dey work as many pipu dey wounder waytn Poosh be or dey just dey talk about how every member of their family dey remove cloth too much just to get on new.   See the picture where she take for bathroom with a tea cup and Mac laptop to cover her oranges while she cross her leg and properly cover her hair.

Joshua Iginla: Anointed man of God say him and em wife don fok oda pipu without condom

Pastor Joshua & Pastor Mrs Yemisi Iginla A raining pastor wey based for Abuja don break one shameful news during Sunday service. He be pastor Joshua Iginla of the Royal Assembly (Church), incase you no know am, na popular Man of God wey dey for TV for many years (televangelist and prophet). He tok for Sunday-Service say him and his wife don fok oda pipu before-before and dey no use condom. Many church members con dey scratch dir head dey wonder waytin their pastor dey yan. To prove say husband and wife dey sleep with other pipu, both of dem get at least one pikin outside marriage (each). He talk say his wife Yemisi, give am em first daughter wey no be em true pikin (dat means his brokus no write her name), but because of shame and Holy Spirit, him lockup and no broadcast the matter. But when na him turn to give another person belle, Yemisi no gree o, she start to dey cast the man everywhere (even after he done lockup for her and no drive her away, she con fall him hand con...