Joshua Iginla: Anointed man of God say him and em wife don fok oda pipu without condom

https://aprokoreport.blogspot.com/2019/03/joshua-iginla-anointed-man-of-god-say.html
Pastor Joshua & Pastor Mrs Yemisi Iginla

A raining pastor wey based for Abuja don break one shameful news during Sunday service. He be pastor Joshua Iginla of the Royal Assembly (Church), incase you no know am, na popular Man of God wey dey for TV for many years (televangelist and prophet).


He tok for Sunday-Service say him and his wife don fok oda pipu before-before and dey no use condom. Many church members con dey scratch dir head dey wonder waytin their pastor dey yan. To prove say husband and wife dey sleep with other pipu, both of dem get at least one pikin outside marriage (each).


He talk say his wife Yemisi, give am em first daughter wey no be em true pikin (dat means his brokus no write her name), but because of shame and Holy Spirit, him lockup and no broadcast the matter. But when na him turn to give another person belle, Yemisi no gree o, she start to dey cast the man everywhere (even after he done lockup for her and no drive her away, she con fall him hand con dey cast am and try to spoil him church business wey dey put food for her American table). Pastor and wife score 1 -1 but she no get weytin oyinbo dey call ‘sportsmanship’ even after he don beg her make dey no ‘hang their dirty underwear outside’.


The thing be say, the woman dey for yankee all these years and expect the Anointed Man of God to dey do soupy? He say he buy her and his children a house wen cost 350 million naira and con put the children for the best school for America, she wan disgrace am and spoil everything dem don work for.


  
Pastor Joshua say he don tire, he no dey do again because his wife no wan gree cool down so he go divorce her. He don warn her before say if she push am to come tok openly, dat mean say the marriage don end. As he don lose control of the wife wen now dey on a mission to spoil him name. He say even though him don wash him hand form the marriage, he go still dey provide for his family for USA in their 350 million naira house.


Aproko Report interview one expert lawyer (Barrister James Ayodele) for the matter and him say: “If you be member of dat church and your wife too dey attend service or visit pastor house, it is advisable to do DNA test for all your children because, as this matter done cast, na normal thing for more women to start to dey come out like Johnson Sulaman, Donald Trump and Bill Cosby”.


Iginla ask em church to pray for him, and beg em bastard daughter make she no vex. He confess say he dey get hypertension. People wen no be church member say the pastor no sorry or get honour, if not he for resign. He just dey vex say em wife no fit cover for him after he cover for her. Even though he bang another woman, na his wife be the first betrayer and last betrayer, tufiakwa! He tok and tok and tok but no reach the part where as a married man for church, em no suppose to dey even eye other women talkless of giving one belle. Even if he be guyman (with bleaching and jerry coil hair), him suppose use protection but he do am raw sotai he  born pikin outside marrage. He dey claim say everything wen happen na spiritual battle and temptation. To say the truth, the only thing wey dey pain the pastor na the wife betrayal to not lockup and die the matter (according to him, she don forget say she open her leg for another man and bring waytin he call an “unholy child” into dir marriage).

Comments