Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

One company don create condom wai no fit break





LELO HEX na de name of one company wai say dir condom no fit break. Dis people gather engineers to make sure say dem go make a condom wai no fit break. Na the first time for de whole world wen anybody don make dis kind of condom.



This na good news to those bros wai day karawa wen dem don high finish, so dey no fit know when condom don break, only to find out later say dey don catch STI or don give person belly.



Like one time wen one bros go meet ashawo, he con reject her Gold Circle say him come with him own, so the ashawo use style put Vaseline for her thing (you know say vasinline dey break condom). As dat condom break, she provoke call her co-worker, they round the guy up until he pay 6k for bringing condom wai break. If say he get this kind LELO HEX robber, he for nor enter one chance.
 
Ei no matta if your toto or him brorkus get needle, dis condom na unbreakable
 

The good thing about dis be say, if the condom break and you dey for America, you fit sue the company go court make dem take care of the pikin, or make them treat the Sexsully Transmited Infection you get as a result of the condom wai break.  

This one na the ultimate bullet proof raincoat.



Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Buhari Dey Warn NDA: 'Come Talk Or Else!'

‎President Mohammadu Buhari don send warning give the Niger Delta Avengers say make dem talk now or him go show them pepper! He say if dey no agree to talk, he go treat dir 4ke up de way he dey do Boko Haram. In case you no know; The Niger Delta Avengers na militant group way dey show say dey go school. Since dem dey blow up pipelines in protest, dey never kill anybody, they just dey post real words for correct English about waiten dey pain dem. Unlike Boko Haram wai no know why dem dey kill people. But Buhari talk say dey go get the medicine of Boko Haram if dem no stop and come talk with government. Ei dey clear say Buhari never find oil for North as he dey search before. So now ei don put eye again for the Niger Delta oil because na from dir 80% of the country money dey come (even as the very small community wai get this oil dey live in poverty).‎ Dos small community no get light while the oil for thier land dey power big big cities and even Ghana. Even if we ove...