How Lessa Fever don create business opportunity wai anybody fit do



Oluwasegun Benson, the CEO of Phosguard Fumigant Limited (which na NGO) done partner with Lagos government for a new program called, operation ‘Kill rats, make money’. The idea be; dem go pay you for every 20 rats you submit.

The chemical company know how dem go handle the dead rats so ei no go cause disease. This ‘Kill Rats, Make Money’ project na tactic to drive lessa fever comort from Lasgidi.




I no wan make una kon say dis one no be serious business o, as research say deiris over 2 billion rodents in Lagos. And because I be shape guy, I done dey make plans to import 12 million more rats so at least I go make minimum of N60m naira (sixty million naira) if na 100 naira per 20 rats but ei go pass that amount sha. You make money as you do good.


I thank the government for this youth empowerment program. Payment go start next month!





Comments