Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Security catch Hausa guy wen dress like fine Fulani chick

In case you dey wounder, we for AprokoReport don confirm say he no dey among the missing Chiboke girls. Him na hustler.


missing bringbackourgirls man dress like woman with hijab
Civil-Defence Officers wolai Hausa-fulani man wen dress like chick with hijab and pure water breast. The bros get woman voice and him dey blush for the camera


This guy put pure water as breast, makeup and hijab, con dey travel go Kaduna. You know as things hard and some men still like to kolo for women, he think say na good idea until dem catch am.
 

I no go lie, the guy fine sha, but all he need na good beauty cream and him voice naturally thin like girl own.
 

If you see am, he day smile self. Like say he no send any body message.
 

For the video, he they tell them say he dey travel to visit eh sister for Kaduna and nothing more o. But me I con dey fear say; hope that him sister no be him brother way dey also dress like woman. I just hope say him sister go wear hijab and cover face come bail am for police station.

Next time you see a girl with big vail, hijab or even cover face, eh fit be this guy or he sister.

Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Military kill 5 suspected militants as Avengers use style dey beg government

Yeye Everywhere! For the website of Niger Delta Avenegers, dem post one kan yeye message wen no get head or tale title: " NDA IS READY WHEN NIGERIA GOVERNMENT IS READY ". Waitn that mean be say, dem dey use style take beg government say they no want war, make dem talk how everybody go get waitn dey need (justic). Nahim Nigerian Military kon release another yeye report say, while dem dey train for Rivers State for one operation 'Crocodile Smile', say dey kill 5 militants and catch 23 other suspect . But the picture wai dey release no con make sense at all. Em be like say dey nab university cultist con dey claim say na militants. See the mumu weapons military say militants dey carry. May be na psychlogical warfare plus government properganda. This na how real militant weapon look like: Nigeria military and Niger Delta Avengers, una try. Make una stop all the forming sitdown settle.