Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

FG blow N3.6 billion naira for “Change Begins With Me” campaign




Recently, President Muhammadu Buhari lunch one campaign of ‘National Orientation’ call “Chang Begins With Me”. This one mean say, dem wan change am for de way country-people dey think. He no wan Nigerians to dey ask government to make things better, instead made you and I do am by ourself, make we work to make things better if we want things to better. Na another way of saying OYO (on your own).

Too many wahala con follow the lunching o. People say Buhari no only copy Obama election campaign style of ‘change’, but he also copily-copy Obama speech (and for yanki, dat na big offence to copy person speech without telling people who you dey copy or quote).  



President Buhari & The Minister of Information Lai Mohammmed
Now the Daily Independence Newspaper don cast the government say this campaign (when government wan change de way we think so we go help our own self) cost government N3.6 billion. That means, if you carry 30,000 people and you share N100k naira equally among them (to start pity trade), you go still get N600 million naira remain.

Daily Independence talk say, The Ministry of Information sign contract with one consultancy group of N1.7 billion so dem go make logo, poster and TV/radio music advertisement.

They kon say dem one spend N700 million pay the people (including celebrities) wai go promote and market the thing.

One Mr Brian Abden who dey lead the consultancy group wen get the N1.7 billion contract denial am sha but governemt lock-up.

Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Buhari Dey Warn NDA: 'Come Talk Or Else!'

‎President Mohammadu Buhari don send warning give the Niger Delta Avengers say make dem talk now or him go show them pepper! He say if dey no agree to talk, he go treat dir 4ke up de way he dey do Boko Haram. In case you no know; The Niger Delta Avengers na militant group way dey show say dey go school. Since dem dey blow up pipelines in protest, dey never kill anybody, they just dey post real words for correct English about waiten dey pain dem. Unlike Boko Haram wai no know why dem dey kill people. But Buhari talk say dey go get the medicine of Boko Haram if dem no stop and come talk with government. Ei dey clear say Buhari never find oil for North as he dey search before. So now ei don put eye again for the Niger Delta oil because na from dir 80% of the country money dey come (even as the very small community wai get this oil dey live in poverty).‎ Dos small community no get light while the oil for thier land dey power big big cities and even Ghana. Even if we ove...