Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

One Week Since Dr. Okowa Disappear!

Dr. Ifeanyi Okowa, Governor Delta State

Ei don reach one week since anybody take eye see the governor of Delta State Dr. Ifeanyi Okowa.

Rumour ‎say the governor faint for governor house wai dey for Asaba, Delta State and dey suffer from one sickness wai nobody understand.

According to one aproko wai dey work inside the governor house, Okowa suppose  ‎attend one Teachers Day Celebration for cenotaph last Wednesday but he no show up as he just collapse for him office.

Everybody wait for the governor to show up but he fall their hand. Dey have to call his deputy, Barrister Kingsley Otuaro make him for represent the governor at the last minute.

The aproko talk say, he witness as dem hurry carry the governor go somewhere nobody know‎.
He talk say since that time, nobody done see am (even him aids). Since last week, you go notice say na the Deputy Governor dey attend ALL the public function. This aproko still dey tell Sahara Reporter‎ say, ei don tai wen Okowa dey suffer from one mystirous sickness. He say since him be senator, he no well.‎ He talk say dis sickness dey affect him blood that na why the governor faint.

Aproko Report contact another aproko who be staff for the Governors House. This aproko talk say na lie. He claim say the governor injure himself when he dey baff for bathroom. The wall of the bathroom fall on top him leg. He say the governor na private man wai hate "sypathy" (Okowa no like make people dey tell am sorry) so him no go comeout until he leg don heal. ‎Our aproko talks say the guy wai spread that rumour say mysterious illness dey worry the governor na wicked person.

Either way, something no dey okay with our governor so I wish am quick recovery.



Comments

Popular posts from this blog

Nigerian popstar Teni pose seductively – Put Miley Cyrus out of business

Teni pose for American Next Top Model Dis big tori don knock as the musician call Teni don start to dey pose in seductive way. She play but may be she no dey play (we for Aproko Report no too sure because she overwight and say he wan join American Top Model TV show). She show her big bakasi and remove her tough like Miley Cyrus. Anyway, enough guys done already volunteer to lash her just incase na kungi dey worry her.

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...