Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Senate Wan Make Buhari Conduct Census By 2018


The Senate for Nigeria don ask president Buhari make him start to dey prepare for de counting of everybody wai dey for Nigeria. This counting na de census.
This na something wen former president Obasenjo been last do (that year, 2006).


So this idea come from the motion wen one Senator Sule Hunkuyi forward for plenary today ‎for Abuja. As usual, them say make government think about am and release money quick quick for de project to succeed.


Hunkuyi use better word take wash the matter say na part of planning o. As usual, they ask for money for the NPOPC (National Population Commision) because better thing na money kill am and as year don dey end, ei go better for government to join am inside 2017 Budget.
He say ei don tai since the last census and by the time 2018 for don reach, ei go be 12 years space between de two census. He say, based on international standard, ei suppose take 2 year to plan proper census.


Another senator, ‎John Enoh say the plan make sense because normally, dem suppose do am every 10 year as the United Nation provision agree. May other senators back am too.


I interview one aproko wen no want him name publish advice him people say, "De result of the censous go help government plan well. So make my people nno dull dem self dis time, you must count your chickens and fish as human being just the way dem count sheep and cows for Kano during Olusegun Obasenjo time".


If ei go hold, everybody must to count and by that way, even government go know how many people Boko Haram to mud since Yahadua time. Me I know go surprise if North still produce billions of people sha.

Comments

Popular posts from this blog

Nigerian popstar Teni pose seductively – Put Miley Cyrus out of business

Teni pose for American Next Top Model Dis big tori don knock as the musician call Teni don start to dey pose in seductive way. She play but may be she no dey play (we for Aproko Report no too sure because she overwight and say he wan join American Top Model TV show). She show her big bakasi and remove her tough like Miley Cyrus. Anyway, enough guys done already volunteer to lash her just incase na kungi dey worry her.

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...