Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

"Free my husband" Nnamdi Kanu's wife dey hala president Buhari



The wife of Nnamdi Kanu (Uchechi Okwu Kanu) don vex for president Mohamadu Buhari wen news reach her say, dem do secret court season for for husband. She dey wonder why dem no tell anybody say court go hold and con trail am for secret. She say she no want dat kan 'wayo'? Dem they kill unarmed pro-Biafra protesters for public and tried Boko Haram suspects for public, so why her husband case different? She say Kanu no be terrorist, say na freedom-fighter (like Mandela) wen wan separate from Nigeria.


Kanu and wife



Nnamdi Kanu na the former director of Radio Biafra when police catch because he too dey talk anyhow about government and dey make-mouth threating government. His wife don accuse government of trying to kill her  husband for prison, and con confess how she dey worry because him health don dey bad more and more. Kanu na UK based guy so even after more than one year, he never yet get used to prison-life and dem no dey give am medical treatment for prison. 

She talk say ei go better make her Kanu stay for prison for 20 years dan for government to dey hide judge her husband.
She say she no go gree for secret trail again. She con provoke get mind call President Buhari a 'madman' (just like Fela of blessed memories call Buhari for 'Beast of No Nation'). She con ask Buhari to free her husband as she clame say he never commit any crime and government no get evidence against him.


Left, Nnamdi Kano. To the right is Justice Binta Nyako


All this she tell IBTimes for UK. Accusing the judge of wayo; She say before-before, she don already talk am say the Judge go 'fall her hand'.‎ She say she no surprise wen she hear the ruling. 
The Judge for the matter na one Justice Binta Nyako who husband get case with government and the judge son also join for the wahala as her son still dey for police detention. ‎So Kano wife talk say, the judge dey try pleas the Nigeria government because her husband and son wahala fit increase if she rule against the government. 




Comments

Popular posts from this blog

Nigerian popstar Teni pose seductively – Put Miley Cyrus out of business

Teni pose for American Next Top Model Dis big tori don knock as the musician call Teni don start to dey pose in seductive way. She play but may be she no dey play (we for Aproko Report no too sure because she overwight and say he wan join American Top Model TV show). She show her big bakasi and remove her tough like Miley Cyrus. Anyway, enough guys done already volunteer to lash her just incase na kungi dey worry her.

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...