Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

PHOTO: Yoruba Prophet give him daughter belle

The ‘miracle working prophet’ Taiwo Oluboyode who be the GO (General Overseer) of one white garment church wen dey for Olr-ljebu Street, Ododr, Idanre area of Ondo State, don confess say na him give him 16 years old daughter belle. The poor girl dey carry the six months old baby of her papa.



 

For police station, the 56 years old man tell olorpa say na devil make am spoil the girl, but people for him area no gree. Dey say him do am to recharge him juju-power, say ne ritual act. The reason why dey accuse am of jazz na because, the community people say the man get power (no be small). Even sef, people too dey rush him church for help and miracles. They say some of them come as far as Maiduguri just to see the prophet. They say everytime he day bath women for river to wash off curses and evil spirit wai dey hold their life backward.




The mama of the girl no dey live with the prophet anymore as she run from her husband house and he no allow her take dir daughter leave. So as him wife leave, the man con turn him piken to bed mate.


Prophet Taiwo
After he notics say she done pregnate, he start to dey hide her for house and dey tell her schoolmate say she don travel go Lagos for school. He even try tp abort the pikin by giving her concoction but the belle still day. This he dey do for secret until a neighbour see the girl with biggie belle, na so Prophet Taiwo enter police net.


As church members her say their prophet dey police station for abomination, dey all find their squareroot. All the church leaders too run because dey no want trouble. Right now, the whole church dey lock and no body wan go near

Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Buhari Dey Warn NDA: 'Come Talk Or Else!'

‎President Mohammadu Buhari don send warning give the Niger Delta Avengers say make dem talk now or him go show them pepper! He say if dey no agree to talk, he go treat dir 4ke up de way he dey do Boko Haram. In case you no know; The Niger Delta Avengers na militant group way dey show say dey go school. Since dem dey blow up pipelines in protest, dey never kill anybody, they just dey post real words for correct English about waiten dey pain dem. Unlike Boko Haram wai no know why dem dey kill people. But Buhari talk say dey go get the medicine of Boko Haram if dem no stop and come talk with government. Ei dey clear say Buhari never find oil for North as he dey search before. So now ei don put eye again for the Niger Delta oil because na from dir 80% of the country money dey come (even as the very small community wai get this oil dey live in poverty).‎ Dos small community no get light while the oil for thier land dey power big big cities and even Ghana. Even if we ove...