Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

PHOTO: Villagers find missing farmer for inside snake belly

Dem don dead-body of one man for inside one giant python. The 25 years old man whos name na Akbar, dispear over the weekend and him family kon dey worry because he tell them he wan hervest palm oil but no come back.

Indigenes for the village of Salubiro wai dey for de eastern island of Sulawesi on Monday cut open a 23-foot snake after dey notice how the snake over big and em no fit move well. Dey also notice say dem fit see trace of person boat for the snake belly and some of Akbar tools dey near wear the snake dey.

The snake swallow the man complete which na something nobody for Salubiro don ever see before.

One expart zoologist talk say, that kind of python fit grow reach 20 feet but for it to chop human being no occational happenings. He say they den chop children sometime but hardly a full grown man and this case na strange one. 



 







Comments

Popular posts from this blog

Nigerian popstar Teni pose seductively – Put Miley Cyrus out of business

Teni pose for American Next Top Model Dis big tori don knock as the musician call Teni don start to dey pose in seductive way. She play but may be she no dey play (we for Aproko Report no too sure because she overwight and say he wan join American Top Model TV show). She show her big bakasi and remove her tough like Miley Cyrus. Anyway, enough guys done already volunteer to lash her just incase na kungi dey worry her.

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...