Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Free my brother! ~ Sheikh Ahmad Gumi blast DSS

On Saturday for the Sultan Bello Mosque; Sheikh Gumi provoke because of how the Department of State Serviices, DSS, hold him Islamic brother wai dey help Fedral Government talk with bandit and kidnappers to free hostages (dis na something Sheikh Gumi done do before). That him Muslim-brother na one Tukur Mamu who be Islamic scholar and writer of the book called 'Desert Herald'.

Sheikh Gumi at the right and Tukur at left. Sheikh Gumi doesn't think that armed man is a terrorist but accuse the DSS of terrorism.



DSS say dem find military materials and plenty money from different country for Tukur Mamu house but Sheikh Gumi say make DSS charge am or free am so Sheikh Gumi fit beg am to cool temper. Sheikh Gumi also call the DSS terrorist for the detention of him Islamic brother Tukur. His family say the military materials DSS find for Tukur house belong to him nephew wai dai military.

Recently he done help Fedral Government settle the kidnappers of the Abuja - Kaduna Train (dis pipu dey for bush since 5 months and they face bad experience I no fit talk for here), and some pipu say he want go spend him share of the ransom for Saudi Arabia while others say he just wan do lesser-hajj with him family. But dem done secretly add him name to international blacklist of dangerous pipu. So as him land Turkey, dir police hold am, he con go Egypt and dey too hold am for airport for 24 hours before dem send him and his family back to Nigeria (dem no want dis kind of person for dir country because him fit start palaba for dem because of him connection to many bad kidnappers). So as him land Nigeria DSS con carry am because dem dey fear waitin he for don tell the authorities of Egypt (if he don implicate any powerful person). So Sheikh Gumi (who also done help Fedral Government talk with kidnappers and bandits to free hustage), con vex say make DSS charge him brother or free am because he no like dis kind of suspicion without prove.

The head of DSS say the matter no be small matter (he describe am as busting brain) and advice everybody to mind dir business made DSS do dir job jejely. He say dem so soon charge Tukur to court. I hope Sheikh Gumi no piss for pant as him Islamic brother fit con talk too much.

Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Military kill 5 suspected militants as Avengers use style dey beg government

Yeye Everywhere! For the website of Niger Delta Avenegers, dem post one kan yeye message wen no get head or tale title: " NDA IS READY WHEN NIGERIA GOVERNMENT IS READY ". Waitn that mean be say, dem dey use style take beg government say they no want war, make dem talk how everybody go get waitn dey need (justic). Nahim Nigerian Military kon release another yeye report say, while dem dey train for Rivers State for one operation 'Crocodile Smile', say dey kill 5 militants and catch 23 other suspect . But the picture wai dey release no con make sense at all. Em be like say dey nab university cultist con dey claim say na militants. See the mumu weapons military say militants dey carry. May be na psychlogical warfare plus government properganda. This na how real militant weapon look like: Nigeria military and Niger Delta Avengers, una try. Make una stop all the forming sitdown settle.