The poor girl wear 'Freedom Fighter' dress. The dress look like something wai artist dey made ('customized'). The thing wen no kon make sense na when dem talk say some boys for car with tinted glasses kidnap her. Dat perticular place no get many cars with tinted glasses and police too dey set for dir to collect rocha and slap boys anyhow. How dat kind car fit pass police, no be say dem be police too? Anyway diris God sha.
Na
one Ossai Ovie Success who be Personal Assitant to Delta State Governor
post the picture online for every body to see. He kon dey thank God for
her life. From the picture, ei clear say dey popo her well, and shave her
hair.At least one pastor go get the delivrance contract for this one.
No reason am o, that mama no know the girl, ei cost 50 naira if you share keke but 500 naira for drop. |
Comments
Post a Comment
Na aproko mata be this so make una no over reason am. I wan make una know say; I no fit agree with everytin way people go comment, but that no mean say I no go post am.