Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Hausa men save girl with freedom-fighter dress from ritualist (Photo)

People for internet shock today as this photo of a girl wai badboys kidnap for tinted car. Dey carry her enter bush wan use her for ritual before Hausa men save her for the bush wai dey for Obiaruku, Delta State.


 




The poor girl wear 'Freedom Fighter' dress. The dress look like something wai artist dey made ('customized'). The thing wen no kon make sense na when dem talk say some boys for car with tinted glasses kidnap her. Dat perticular place no get many cars with tinted glasses and police too dey set for dir to collect rocha and slap boys anyhow. How dat kind car fit pass police, no be say dem be police too? Anyway diris God sha.





 


  
Na one Ossai Ovie Success who be Personal Assitant to Delta State Governor post the picture online for every body to see. He kon dey thank God for her life. From the picture, ei clear say dey popo her well, and shave her hair.At least one pastor go get the delivrance contract for this one.


No reason am o, that mama no know the girl, ei cost 50 naira if you share keke but 500 naira for drop.




Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

Nigerian popstar Teni pose seductively – Put Miley Cyrus out of business

Teni pose for American Next Top Model Dis big tori don knock as the musician call Teni don start to dey pose in seductive way. She play but may be she no dey play (we for Aproko Report no too sure because she overwight and say he wan join American Top Model TV show). She show her big bakasi and remove her tough like Miley Cyrus. Anyway, enough guys done already volunteer to lash her just incase na kungi dey worry her.

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...