Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Come see wahala o, as IDP block road

You know how condition of the economy dey and how everything dair, how some heartless governors never pay state civil servants for months and everybody dey hustle twice as much to get half of waiten we dey earn before before?

Internally Displace People IDP (dem soso people wai Boko Haram force run commort for their village‎), them wait for government manna and em no show. Omor dey provoke say which kind thing be this? Hungry man na angry man. Dey block road make everybody know say them never chop food. Na food dey want, so dey go go sht for toilet and sleep.

The thing bad sotay motor no fit move front or move back (HOLD-UP on a hot Thusday)! Many of the stranded people wan just pass go where dem dey go, no be say dem dey stay for Brono State or anything like dat, na passa byes, some na strangers who dey find dir own daily bread.
 

 


Dem dey tell the reporter wen take the photo (wen day up) say, "we never belly-full for weeks and now we no see even that small one chop! We no go gree! We no go gree!! We no go gree oooo!!!"




Dem talk say dey no want one committee way dey share food for them because the members of dat committee too dey tap dir food. They want their food staright from government.

Now why ei be say dat state governor never hear the oyinbo proverb way say; "give a (wo)man a fish and he would come back tomorrow", but tish am how to fish and em no go come disturb you?







In case you no know, 450 PIKINS die of HUNGER for these type of camp ‎last year and many many more still dey H!



Diris dignity in labour, na time to train and send dis people off make dem hustle like everybody else. This one no be life na existence joor! Instead of ask for food, make dem ask for job and restart to dey live life "reinteragtion into socity".

Comments

Popular posts from this blog

Nigerian popstar Teni pose seductively – Put Miley Cyrus out of business

Teni pose for American Next Top Model Dis big tori don knock as the musician call Teni don start to dey pose in seductive way. She play but may be she no dey play (we for Aproko Report no too sure because she overwight and say he wan join American Top Model TV show). She show her big bakasi and remove her tough like Miley Cyrus. Anyway, enough guys done already volunteer to lash her just incase na kungi dey worry her.

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...