Brother Onesmus Kinyua wai dey play instrument for church all the time do something wai shock everybody for Kenya.
This na beta Christian wen always dey for church but den he go Facebook post picture of him and him wife as they hold each other for bed (may be after action).
His friend dem, kon dey vex with am say make him maintain and stop to dey act like mumu, but my guy no gree.
Ei be like say this church man wan tune badboy as him put for the photo “Babie & me enjoyable day”.
I dey happy say ne him wife but he forget say he dey for Africa? Since na him wife and he no post the main thing, I no expect am to kill himself like that South African pastor wen cast yesterday.
Comments
Post a Comment
Na aproko mata be this so make una no over reason am. I wan make una know say; I no fit agree with everytin way people go comment, but that no mean say I no go post am.