Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Nigeria go soon dey for darkness in few weeks time


         
The Managing Director and Chief Executive Officer, Egbin Power Plc, Mr. Dallas Peavey, Jr. don speak him mind recently. He dey tell government “pay me my money or we go off light for all-de whole Nigeria".

He say he no like waiten government dey do as dey shun am for 6 month without pay. He say he go give Nigeria ‘darkness’ if money no land him hand in the next few weeks.

He say since dem land Nigeria 3 years ago, dem dey use our of their savings take sponsor all their project dem day do so dis time wen Lai Mohammed go say na Jonathan cause am, ei fit dey tell small truth.

He complain say fuel na problem and some of the spear part dem dey use don old well well, I mean, the man complain no be small.

He tell the reporter Femi Asu of The Nation Newspaper say our Federal Government dey own him company N86 billion.


He say him na business he wan run, so profit important as he no fit they provide light for Nigeria from his company pocket. But him say, de only thing he want, na the money FG dey owe am, say he never even start to dey talk about profit or gain as things bad sotay he never even think about day one.


 
When this misister still be governor of lasgidi, he claim say he use millions of naira design website wen you fit design for only 3k.






Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Military kill 5 suspected militants as Avengers use style dey beg government

Yeye Everywhere! For the website of Niger Delta Avenegers, dem post one kan yeye message wen no get head or tale title: " NDA IS READY WHEN NIGERIA GOVERNMENT IS READY ". Waitn that mean be say, dem dey use style take beg government say they no want war, make dem talk how everybody go get waitn dey need (justic). Nahim Nigerian Military kon release another yeye report say, while dem dey train for Rivers State for one operation 'Crocodile Smile', say dey kill 5 militants and catch 23 other suspect . But the picture wai dey release no con make sense at all. Em be like say dey nab university cultist con dey claim say na militants. See the mumu weapons military say militants dey carry. May be na psychlogical warfare plus government properganda. This na how real militant weapon look like: Nigeria military and Niger Delta Avengers, una try. Make una stop all the forming sitdown settle.