Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Witch crash-land for Benin city church (Video and Photos)






This bros confess saw him na wizard. He say he crash land for the church compound without any cloth. People say, he ‘spiritual google map’ spoil for air as he dey fly. 



The Prophet
 So this na the real tori:

Church worker come church eairly in the morning make dem start to dey work. As dey open gate, dey see this guy just walker round the place with no cloth. Dey confuse because, they lock everywhere well well and church gate get razor to stop any one wai try jump am.

After dey ask the bros, he say, him na witch and he crash land and wan give him life to Christ. They ask am him mission be he say him no even know him mission.


If na spititaul google map, and spiritaul flying, spiritual mission, how come he con physically crash-land? If he physically crash-land, how come he fit waka? To fall from sky no be childs, him surpose get serious injury.

 




 After I watch the report by ITV, I now know say this bros na thief wai miscalculate, but adjust him plan well. So na so this guy use sense excape jungle justic and police (because police no dey arrest for witchcraft). They go deliver am and let am go free.




Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Military kill 5 suspected militants as Avengers use style dey beg government

Yeye Everywhere! For the website of Niger Delta Avenegers, dem post one kan yeye message wen no get head or tale title: " NDA IS READY WHEN NIGERIA GOVERNMENT IS READY ". Waitn that mean be say, dem dey use style take beg government say they no want war, make dem talk how everybody go get waitn dey need (justic). Nahim Nigerian Military kon release another yeye report say, while dem dey train for Rivers State for one operation 'Crocodile Smile', say dey kill 5 militants and catch 23 other suspect . But the picture wai dey release no con make sense at all. Em be like say dey nab university cultist con dey claim say na militants. See the mumu weapons military say militants dey carry. May be na psychlogical warfare plus government properganda. This na how real militant weapon look like: Nigeria military and Niger Delta Avengers, una try. Make una stop all the forming sitdown settle.