Atiku hit the gym in preparation to join Arsenal FC by
January 2017. At least na so him talk as he post picture of him workout.
The former VP no dey rest as he prove say even for play, him na confirm politician. He con make sure say dey find am a trainer wai resemble Goodluck Ebele Jonathan. Na political tactics to just confuse people. I no know why dem no go allow Jonathan rest.
In case you no know; Atiku Abubakar na the former Vice
President of Nigeria and person wai don day run for de post of president since
he leave office.
Na so we see am. Some
people don dey provoke say dey no want am for Arsenal while some say “Sai Atiku
2019”. Anyway, dis na part of publicity try show say the man na human being. I
know say Obasanjo fit workout but I doubt if our current president go fit.
Comments
Post a Comment
Na aproko mata be this so make una no over reason am. I wan make una know say; I no fit agree with everytin way people go comment, but that no mean say I no go post am.