Reopening Universities in Nigeria – Student don tire

 


Nigerian government don announce say dem go re-open all the whole
Federal Government schools wen dey Nigeria. That means say, if na Federal Government school, ei go open by October 12, 2020. Ei no matter wada na Univeristy, Polytechnic, Collage or Unity Schools, as long as say Federal Government own the school, dey must open next two Monday on the October 12, 2020. Say dem want make dem finish dir semester kpata-kpata since dem don sit for house too long because of korona wahala.



The Federal Government don also advise private schools and State Government School, make dem put head together find way to reopen dir own school make students start to dey learn.



If you remember, schools for Naija don close since March of dis year because of the kata-kata things wai dey happen for the rest of the world because of Korona. Dat time government say make everyone stay for house so dem no go catch and spread the sickness.

The Minister of Education, Mallam Adamu Adamu,say since the number of pipu wen report get the sickness dey reduce, it make sense to reopen school. He said he done agree and talk with everybody wai get mouth for this matter including the Association of Private Schools (NAPPS), Provosts of Colleges of Education, Rectors of Polytechnics, Vice Chancellors of Universities, State Governors, Commissioners of Education, business pipu and NGO. He say everybody must do dir best to make sure all student and staff are safe. They must practice social distancing, wash their hands and wear mask otherwise na palaba for that school.



The Minister warn say all schools must make sure say encourage water dey (and hand sanitation too).



So starting from October 12, school go reopen again.

 

Source: https://www.premiumtimesng.com/news/top-news/417645-unity-schools-to-resume-october-11-adamu-adamu.html 

Comments