Skip to main content

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Reopening Universities in Nigeria – Student don tire

 


Nigerian government don announce say dem go re-open all the whole
Federal Government schools wen dey Nigeria. That means say, if na Federal Government school, ei go open by October 12, 2020. Ei no matter wada na Univeristy, Polytechnic, Collage or Unity Schools, as long as say Federal Government own the school, dey must open next two Monday on the October 12, 2020. Say dem want make dem finish dir semester kpata-kpata since dem don sit for house too long because of korona wahala.



The Federal Government don also advise private schools and State Government School, make dem put head together find way to reopen dir own school make students start to dey learn.



If you remember, schools for Naija don close since March of dis year because of the kata-kata things wai dey happen for the rest of the world because of Korona. Dat time government say make everyone stay for house so dem no go catch and spread the sickness.

The Minister of Education, Mallam Adamu Adamu,say since the number of pipu wen report get the sickness dey reduce, it make sense to reopen school. He said he done agree and talk with everybody wai get mouth for this matter including the Association of Private Schools (NAPPS), Provosts of Colleges of Education, Rectors of Polytechnics, Vice Chancellors of Universities, State Governors, Commissioners of Education, business pipu and NGO. He say everybody must do dir best to make sure all student and staff are safe. They must practice social distancing, wash their hands and wear mask otherwise na palaba for that school.



The Minister warn say all schools must make sure say encourage water dey (and hand sanitation too).



So starting from October 12, school go reopen again.

 

Source: https://www.premiumtimesng.com/news/top-news/417645-unity-schools-to-resume-october-11-adamu-adamu.html 

Comments

Popular posts from this blog

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

 One oga for police wai dey for Tampa, Florida, shoot himself for head some hours after dem bin quarrel with im wife for one hotel.   The Police Department come release bodycam video wey show the time wey Alfredo "Freddy" Ramirez and im wife dey inside their hotel room and police come approach dem.    Ramirez, wey be the Director of Miami-Dade Police Department, e been get one fight with im wife, and she talk say he get "plenty demons from the job." E survive the shooting but e dey for very bad condition for hospital.  

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

Military kill 5 suspected militants as Avengers use style dey beg government

Yeye Everywhere! For the website of Niger Delta Avenegers, dem post one kan yeye message wen no get head or tale title: " NDA IS READY WHEN NIGERIA GOVERNMENT IS READY ". Waitn that mean be say, dem dey use style take beg government say they no want war, make dem talk how everybody go get waitn dey need (justic). Nahim Nigerian Military kon release another yeye report say, while dem dey train for Rivers State for one operation 'Crocodile Smile', say dey kill 5 militants and catch 23 other suspect . But the picture wai dey release no con make sense at all. Em be like say dey nab university cultist con dey claim say na militants. See the mumu weapons military say militants dey carry. May be na psychlogical warfare plus government properganda. This na how real militant weapon look like: Nigeria military and Niger Delta Avengers, una try. Make una stop all the forming sitdown settle.