Nnamdi Kanu’s tweet removed amidst Twitter ban in Nigeria

Nnamdi Kanu tweet that violate Twitter's TOA

The new thing for Nigeria now, na to dey yan anyhow for Twitter sotay Twitter go remove waitin them talk.

President Buhari go yan anyhpow for twitter. He tell all the youth way dey protest onto Biafra matter, say dem go see pepper. Na Twitter remove him tweet tok say dem no like as it fit ginga pipu to ki.

Na out president provoke o, he con ban Twitter from Nigeria. He tell all the whole network like MTN, Glo, Airtel, 9 Mobile and others, make dem make sure to block twitter so no countryman go fit reach the site or use the app.

As if that one no be enough drama. Small time pass and Mazi Nnamdi Kanu con tweet say him to finish any solider way come Biafra land (he promise he con clean every last one, say dem no go go home). Twitter con see say this too fit ginga and vex pipu to start to day ki, so Twitter remove him tweet the same way dem do Buhari.




Ha, me I don tire. Na so dem day use Twitter na? To dey broadcast how dem go ki many many pipu? God abeg o.

Mazi Kanu dey safely for London for Obodo Oyinbo, and Buhari dey for Aso Rock with 300 bodygauilds.


>> "Free my husband" Nnamdi Kanu wife dey hala president Buhari <<

Comments