Skip to main content

Posts

Showing posts from September, 2016

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Witch crash-land for Benin city church (Video and Photos)

This bros confess saw him na wizard. He say he crash land for the church compound without any cloth. People say, he ‘spiritual google map’ spoil for air as he dey fly.  The Prophet  So this na the real tori: Church worker come church eairly in the morning make dem start to dey work. As dey open gate, dey see this guy just walker round the place with no cloth. Dey confuse because, they lock everywhere well well and church gate get razor to stop any one wai try jump am. After dey ask the bros, he say, him na witch and he crash land and wan give him life to Christ. They ask am him mission be he say him no even know him mission. If na spititaul google map, and spiritaul flying, spiritual mission, how come he con physically crash-land? If he physically crash-land, how come he fit waka? To fall f rom sky no be c h ilds , him surpose get serious injury.    After I watch the report by ITV, I now know say this bros na thief wai miscalculate, but adju...

Fulani-Herdsman Arraigned For Enugu Because He Dey Carry Automatic Gun

No reason am, fulani wicked o. Some pipul think say dey na muslem, dey like muslem but dir cow be dir god. So if you get farm and their cow dey hungry, dem go drive you away with fear so dir cow go chop. If dir pikin sick and dir cow sick, dem go buy medicine for the cow.   Enugu State command of the Nigeria Police Force don arraigned one ‘fulani’, Ibrahim Adamu for one Enugu magistrate’s court. Last month (August 29, 2016), police catch Adamu for Affa, Udi LGA of Enugu State with AK47 riffle and 24 bullets. Since he no get permission to carry that kind weapon, dey charge am with armed robbery and possession of illegal gun. Press release from the police talk say de suspect show for Court 1 in Enugu East headed by D.K Ekoh, a chief magistrate grade 1, and after every-every, dem carry am back to prison until he go hear him jail sentence if dem find am guilty.

PHOTO: Girl remove her oga brokus with her teeth

Eric Ansah Andoh na de oga wai lost him John-Thomas One oga firefighter for Ghana, try to sleep with a girl wai dey work under am. De girl name na Ataa Takyi and she be among the Youth Enterprise Agency (YEA) personnel sent to the Techiman Fire Station. She beg the man say she no want, but he still open eye for her say him na oga to her so she better arrange make him chop. Since he no fit read waiten day her mind, she play am as the mumu oga no know de kind craze he dey deal with. Long story short, she bit his prick as de man fall down yakata (hallaring in pain and fever). The other Fire Officers rush am to hospital while Takyi report herself to police.

Girl vex people as she pose with weed and Bible

Dis girl no try. She post picture for Facebook with eibo for one hand and Bible for the other hand. People for Facebook provoke as dem day curse her. From her tattoo, ankle band and dat village bench, dis girl na confirm bad girl. I swear, she resemble dose kind chick you fit give 1k and chuck her.      From de way dem blast dis girl, ei almost resemble dat year wen Goodluck Jonathan remove fuel subside. But some people kon dey defend her say, na God create weed. From her eye, I know say she no dey understand wait n she dey read. Me n , I miss those Niger Delta (Kwale) weed ! As a old-school smoker, me never try dat kind thing out of respect, because the fire fit spoil the page. Na after smoking I fit read my B ible just like Bob Marley who smoke and read Bible pass all of us.

PHOTO of ritualist police nab with human heart

The white plastic plate containing her heart. I sure say you hear dis one for new (radio and TV) but never see the picture. Police catch this boy ritualist with fresh human heart, dem be; Nurudeen Adeniyi, 34, Tunde Banjo, 29, Temitope Alaba 20, and Tobi Olukoya , 20, all of dem confessed say na dem do am. Waiten dem do? Dey kidnap a innocent 16 years old girl from Ago Iwoye area, den dey wan abuse her but she no gree so dey cham her and kill her.

Nigeria go soon dey for darkness in few weeks time

          The Managing Director and Chief Executive Officer, Egbin Power Plc, Mr. Dallas Peavey, Jr. don speak him mind recently. He dey tell government “ pay me my money or we go off light for all-de whole Nigeria ". He say he no like waiten government dey do as dey shun am for 6 month without pay. He say he go give Nigeria ‘ darkness ’ if money no land him hand in the next few weeks. He say since dem land Nigeria 3 years ago, dem dey use our of their savings take sponsor all their project dem day do so dis time wen Lai Mohammed go say na Jonathan cause am, ei fit dey tell small truth. He complain say fuel na problem and some of the spear part dem dey use don old well well, I mean, the man complain no be small. He tell the reporter Femi Asu of The Nation Newspaper say our Federal Government dey own him company N 86 billion. He say him na business he wan run, so profit important as he no fit they provide light for Nigeria from his...

FG blow N3.6 billion naira for “Change Begins With Me” campaign

  Recently, President Muhammadu Buhari lunch one campaign of ‘ National Orientation ’ call “ Chang Begins With Me ”. This one mean say, dem wan change am for de way country-people dey think. He no wan Nigerians to dey ask government to make things better, instead made you and I do am by ourself, make we work to make things better if we want things to better. Na another way of saying OYO (on your own). Too many wahala con follow the lunching o. People say Buhari no only copy Obama election campaign style of ‘change’, but he also copily-copy Obama speech (and for yanki, dat na big offence to copy person speech without telling people who you dey copy or quote).   President Buhari & The Minister of Information Lai Mohammmed Now the Daily Independence Newspaper don cast the government say this campaign (when government wan change de way we think so we go help our own self) cost government N 3.6 billion. That means, if you carry 30,000 peo...

Mad-woman attack man because Konji day worry her (Video)

Konji make this woman to dey demand help for public. She con disgrace this bros wai just dey mand him business. Turely water no get enermy, even craze people body dey sometimes ask for touch. Surpose she code am, enough people go bang her until she go normal again. This one happen in fro nt of one fast-food restaurant.

Nigerian Doctor go jail because of de kind of blue-film he store for phone (Graphic Photo)

One Nigerian Doctor wai dey practice for Britain don go sht for church. Dr Cyprian Okoro mess up when he receive some yeye blue-film from Whatsapp but no delete dem. Among the kind of things he store na video of man and snake, woman and dog, woman and horse. The thing wai destroy him chance of forgiveness na when the mumu go store video of two small boys wen no were cloth (Oyinbo no dey play with dat kind matta at all). Although Okoro denial am say he no know anything about the films, the jury for court no gree, dey say he dey guilty and must go jail (evidence no day lie). Even the judge say dat kind picture no make sence, say he just dey follow due-process if not he for nor waste time send the doctor go jail with immidate-effect.     The 55 years old doctor don go jail before. Two years ago, dem jail am for 6 months because one woman say he try to touch her. So that record no help him matta too. This UK, people too dey go jail over anything. If na Nigeri...

This thief don suffer (Graphic Photo)

When I dey young, dem say, "if you think say you get mind, somebody wen get mind pass you dey". This BOY theif phone kon run but dem catch am so dey banebeat him face. You see, him na small boy. No be say na chinese man, na the beating him get na reconstruct his face.   Now the kind phone he theif na Nokia touch light! Dem say he snach the phone fron one girl hand kon dey run wen the girl start to hala "thief! thief!!". Anyway, some of thr mark wai dem him body na old one but this guy see oba sha. I don day fear that comunity because men no get joy for dir. Dem say dis thing happen for Sierra Leone . Even the people wai dey watch surprise the way dey beat this thief. Dey don hand am over to police. S econd-hand value of that phone na N 1500 (I swear to God). Since the thing no get charger ei fit go for 1k.   Today he find out say, ordinry pipul wai dey waka de street dey vex for dir mind.

We No Dey Give Admission Through Text Message ~ UNILAG

Authorities for University of Lagos talk say dem no dey give admission through text message. Dem dey warm everybody, “make una no fall for yahoo-boyz because we no dey send admission through text”. Any text meassage you receive sayin you don get admisiion for UniLag na wayo o. The school don advice say make you delete that message, no be dem send am. This na because many candidates dey restless as dem dey look for admission so, ei dey easy for 419 to play dem because dem dey hope for admission. So remember; University of Lagos no dey send admission through text message or SMS. If you wan donate money give 419 for free, you fit reply de message (na your cup of tea).

Church minister post picture of him and wife after romancing

      Brother Onesmus Kinyua wai dey play instrument for church all the time do something wai shock everybody for Kenya.   This na beta Christian wen always dey for church but den he go Facebook post picture of him and him wife as they hold each other for bed (may be after action). His friend dem, kon dey vex with am say make him maintain and stop to dey act like mumu, but my guy no gree.  Ei be like say this church man wan tune badboy as him put for the photo “Babie & me enjoyable day”. I dey happy say ne him wife but he forget say he dey for Africa? Since na him wife and he no post the main thing, I no expect am to kill himself like that South African pastor wen cast yesterday.  Some aproko kon dey ask why him eye red and who tish am de word 'bab ie '.

Pastor kill himself after he take mistake send picture of em prick to Church Whatsapp Group

  This na yeye story.   One pastor of Christ Embassy for Limpopo, South Africa go 4ke up send picture of em brokus to his own Church Whatsapp Group. After the man don see his mistake, he hide for him house for one day, stop to dey answer phone calls, and den kill himself after overthinking. The thing wai no make sense be say, on top the picture, the pastor write "wife's away, it's all yours tonight" so ei dey clear say him dey cheat on his wife.  Church mem bers kon dey suspect say he dey friend one church member call Mariam and since him gat to keep am coded, he for don use a name wai resemble his church name take save her number for him phone.‎ So na big mistake ‎Pastor Letsego make.   Me I still dey 20 something years old and I never snap my prick before so I no fit understand why a matured pastor fit joncee like this.

"Rice too dair for market because Nigerians too dey chop am" ~ Minister of Agriculture

  Audu Ogbeh who be 'The Minister of Agriculture and Rural Development' don break one big secret as to why rice too expensive. He say we people too dey chop am, if we take am sufry sufry, de price go come down. From waitn he don tell Nigerians, dem fit use their head reason the matter. If you want the price to come down, stop to dey chop rice and sellers go reduce price to attract customers. Na demand and suppy theory wai dem dey tish for secondary schools. He dey beg Nigerians make dem change am for the rice sellers. He beg Nigeria to start to dey chop potatoes ‎instead of rice-rice all de time. Say chopping of rice too much no good for your body.

Selfie of female US Marine from Nigeria, West Africa

This na the seifies of a fine young black girl wai just graduate university and now she don join US Marin Corps. She dey ambitious and dey jinja to do beta for the United State Marine. Her name na Funmi dat mean say na Yuroba girl.  

Photo of Asari Dokubo With Him Pikens As Dey Celebrate Sallah

Na humble jollification yesterday (12th September 2016) as the Ex-militant and founder of the Niger Delta People’s Volunteer Force snap many photo with his pikens for the Eid ground for Port Harcourt, Rivers State.   After prayers, he kon reture home with his children. They plenty sha, de man dey try. Him suppose get the name Ibrahim because him na ‘father of many’. Baraka da Sallah Mujahid.