Skip to main content

Posts

Oga police fire himself for head (for obodo oyinbo)

Recent posts

Free my brother! ~ Sheikh Ahmad Gumi blast DSS

On Saturday for the Sultan Bello Mosque; Sheikh Gumi provoke because of how the Department of State Serviices, DSS, hold him Islamic brother wai dey help Fedral Government talk with bandit and kidnappers to free hostages (dis na something Sheikh Gumi done do before). That him Muslim-brother na one Tukur Mamu who be Islamic scholar and writer of the book called 'Desert Herald' . Sheikh Gumi at the right and Tukur at left. Sheikh Gumi doesn't think that armed man is a terrorist but accuse the DSS of terrorism. DSS say dem find military materials and plenty money from different country for Tukur Mamu house but Sheikh Gumi say make DSS charge am or free am so Sheikh Gumi fit beg am to cool temper. Sheikh Gumi also call the DSS terrorist for the detention of him Islamic brother Tukur. His family say the military materials DSS find for Tukur house belong to him nephew wai dai military. Recently he done help Fedral Government settle the kidnappers of the Abuja - Kaduna Tra...

Nnamdi Kanu’s tweet removed amidst Twitter ban in Nigeria

Nnamdi Kanu tweet that violate Twitter's TOA The new thing for Nigeria now, na to dey yan anyhow for Twitter sotay Twitter go remove waitin them talk. President Buhari go yan anyhpow for twitter. He tell all the youth way dey protest onto Biafra matter, say dem go see pepper. Na Twitter remove him tweet tok say dem no like as it fit ginga pipu to ki. Na out president provoke o, he con ban Twitter from Nigeria. He tell all the whole network like MTN, Glo, Airtel, 9 Mobile and others, make dem make sure to block twitter so no countryman go fit reach the site or use the app. As if that one no be enough drama. Small time pass and Mazi Nnamdi Kanu con tweet say him to finish any solider way come Biafra land (he promise he con clean every last one, say dem no go go home). Twitter con see say this too fit ginga and vex pipu to start to day ki, so Twitter remove him tweet the same way dem do Buhari. Ha, me I don tire. Na so dem day use Twitter na? To dey broadcast how dem go ki many man...

Reopening Universities in Nigeria – Student don tire

  Nigerian government don announce say dem go re-open all the whole Federal Government schools wen dey Nigeria. That means say, if na Federal Government school, ei go open by October 12, 2020 . Ei no matter wada na Univeristy, Polytechnic, Collage or Unity Schools, as long as say Federal Government own the school, dey must open next two Monday on the October 12, 2020. Say dem want make dem finish dir semester kpata-kpata since dem don sit for house too long because of korona wahala. The Federal Government don also advise private schools and State Government School, make dem put head together find way to reopen dir own school make students start to dey learn. If you remember, schools for Naija don close since March of dis year because of the kata-kata things wai dey happen for the rest of the world because of Korona. Dat time government say make everyone stay for house so dem no go catch and spread the sickness. The Minister of Education, Mallam Adamu Adamu,say since the number ...

46 years old man fuq him best friend 7 years old (deaf & dumb) pikin.

Mr. Ifeanyi Atogu   The police for Anambra state don nab one 46 years old animal wai dem dey call; Mr. Ifeanyi Atogu of Ofenta Nsugbe in Anambra East LGA of the state. Dem say Ifeanyi enter him padi 7 years old daughter. For inside a statement wai police release through dir spokesman Haruna Mohammed, the police tok say, may be the suspect for don use wayo draw the small girl, den con do her bad say because she be deaf and dumb , he think say she no body go ever know. So na so he use manipulation 'take-advantage' of him own friend pikin wai be only 7 years old. They rush the girl go hospital where the doctor check and confirm say someone true-true don enter the poor child and spoil ‘that place’. Dis animal wai dem dey call Ifeanyi Atogu don confess with him mouth say true-true him do am but he blame devil. He tok say na devil push am? May be the police should call the devil for questioning as Ifeanyi don place serious allegation against the devil. Even though the man do...

How the illuminati & Nigeraian Scammers are using the new snapchat filter?

In case you no know, the raining mobile app called Snapchat don bring out a new filter wen go make man become woman and woman into men. De technology na advance and you fit make video and not just picture with it. They want to dey make men know how dey look if dey be woman and all the men wen try am, comort are very beautiful women. Dis na endtime tactics to make men con dey lyk to be woman. Waiten dem dey call transgender or drag-queen for oyinbo land.  Many pipu don already start to dey test the filter as laughing matter, na just play and em funny die. E no go long before the men go start to dey wear womens cloth because Snapchat done alredy show dem say dey beautiful. E no go long before girls too go start to dey wear men cloth because of dis filter. Tufiakwa. Yahoo boyz done already start to dey test this feature because dating scam sure pass all oda format for 419. That means say, if you fit find oyinbo wai dey look for love, you go quick make money pass all those Sa...

Nigerian popstar Teni pose seductively – Put Miley Cyrus out of business

Teni pose for American Next Top Model Dis big tori don knock as the musician call Teni don start to dey pose in seductive way. She play but may be she no dey play (we for Aproko Report no too sure because she overwight and say he wan join American Top Model TV show). She show her big bakasi and remove her tough like Miley Cyrus. Anyway, enough guys done already volunteer to lash her just incase na kungi dey worry her.

Kourtney Kardashian remove cloth for Instagram b’cos of her Poosh

With over 74 million Instgrama profiles following her, the 40 years old Kourtney Kardashianer commot all her dress snap picture post for her Insagram profile. All this she do for publicity for her upcoming brand called Poosh which don already get over 2 million followers before the lunching. Dat means say before pipu even know waytn the label be about, dey don ready to follow am so dey go know dem as the one wey sabi new trend. In case you no know, she be mother (MILF) but look like cici wen never born. Her move don already start to dey work as many pipu dey wounder waytn Poosh be or dey just dey talk about how every member of their family dey remove cloth too much just to get on new.   See the picture where she take for bathroom with a tea cup and Mac laptop to cover her oranges while she cross her leg and properly cover her hair.

Joshua Iginla: Anointed man of God say him and em wife don fok oda pipu without condom

Pastor Joshua & Pastor Mrs Yemisi Iginla A raining pastor wey based for Abuja don break one shameful news during Sunday service. He be pastor Joshua Iginla of the Royal Assembly (Church), incase you no know am, na popular Man of God wey dey for TV for many years (televangelist and prophet). He tok for Sunday-Service say him and his wife don fok oda pipu before-before and dey no use condom. Many church members con dey scratch dir head dey wonder waytin their pastor dey yan. To prove say husband and wife dey sleep with other pipu, both of dem get at least one pikin outside marriage (each). He talk say his wife Yemisi, give am em first daughter wey no be em true pikin (dat means his brokus no write her name), but because of shame and Holy Spirit, him lockup and no broadcast the matter. But when na him turn to give another person belle, Yemisi no gree o, she start to dey cast the man everywhere (even after he done lockup for her and no drive her away, she con fall him hand con...

SHOCKER: President Trump give reasons why Obama cause Syria Chemical Attack

President Donald Trump say na because of the way Obama dey do as president, na make Syria done day use chemical weapon. He say, if Obama take dem seriously, things for no bad reach how dem be today. Chemical weapons na also waytn oyinbo dey call “Weapons of Mass Distruction” (WMD) which mean say, na dat kind of weapon wai day kill plenty people at once. Dozens of people die on Tuesday (4th April 2017) wen dem bomb one hospital while many injured civilians dey get treatment from chemical attack. Human Right Activists tok say de attack na one of the badest since fighting don start for dat country for six-year now. Life for Syria na suffer-head. On top of all the killing and flying bullet, dis bad attack don join put. Among the people when suffer from the chemical attack, na women, children and innocent people wen no join mouth for the fight matter. Trump blast Obama say for 2012, Obama say US no go gree for President Assad of Syria to use chemical weapons, Obama say if he dear...

PHOTO: Villagers find missing farmer for inside snake belly

Dem don dead-body of one man for inside one giant python. The 25 years old man whos name na Akbar, dispear over the weekend and him family kon dey worry because he tell them he wan hervest palm oil but no come back. Indigenes for the village of Salubiro wai dey for de eastern island of Sulawesi on Monday cut open a 23-foot snake after dey notice how the snake over big and em no fit move well. Dey also notice say dem fit see trace of person boat for the snake belly and some of Akbar tools dey near wear the snake dey. The snake swallow the man complete which na something nobody for Salubiro don ever see before. One expart zoologist talk say, that kind of python fit grow reach 20 feet but for it to chop human being no occational happenings. He say they den chop children sometime but hardly a full grown man and this case na strange one.     

Man kill his 8 years old wife with his brokus

This one na one yama-yama story from Hardh wai dey for northern Yeman. One 40 years old matured man married a 8 years old girl. On the night of their wedding, he try to enter her and end up killing the poor child. This one na the same country wen that former Zafara State Governor go get his 13 years old bride that year. The ma no shame because na their culture and religion to marry small children. Even though the girl never matured and he old enough to be her grand father, he man no fit control himself and con end up injouring the girl until she die. The report we get say, she bleed to death from the inside. The thing be say, for that country, the man no commit any crime since he done marry the girl 12 hours before he injure her. Human Right Activites done dey ask for the government to arrest the 40 years old man but no body send dem. This na public mass marrage for Gaza This marrage happen for Afghn jj

PHOTO: Yoruba Prophet give him daughter belle

The ‘miracle working prophet’ Taiwo Oluboyode who be the GO (General Overseer) of one white garment church wen dey for Olr-ljebu Street, Ododr, Idanre area of Ondo State, don confess say na him give him 16 years old daughter belle. The poor girl dey carry the six months old baby of her papa.   For police station, the 56 years old man tell olorpa say na devil make am spoil the girl, but people for him area no gree. Dey say him do am to recharge him juju-power, say ne ritual act. The reason why dey accuse am of jazz na because, the community people say the man get power (no be small). Even sef, people too dey rush him church for help and miracles. They say some of them come as far as Maiduguri just to see the prophet. They say everytime he day bath women for river to wash off curses and evil spirit wai dey hold their life backward. The mama of the girl no dey live with the prophet anymore as she run from her husband house and he no allow her take dir daughter leave. ...

"Free my husband" Nnamdi Kanu's wife dey hala president Buhari

The wife of Nnamdi Kanu (Uchechi Okwu Kanu) don vex for president Mohamadu Buhari wen news reach her say, dem do secret court season for for husband. She dey wonder why dem no tell anybody say court go hold and con trail am for secret. She say she no want dat kan 'wayo'? Dem they kill unarmed pro-Biafra protesters for public and tried Boko Haram suspects for public, so why her husband case different? She say Kanu no be terrorist, say na freedom-fighter (like Mandela) wen wan separate from Nigeria. Kanu and wife

JUJU: Bros brokus move to him lap after he bang another man wife (Photo)

This news break for Kanya. One bros come out publicly dey beg people for forgiveness. He claim say him brokus move down to him right lap after he sleep with another man wife. People say na juju. Them say the woman too dey cheat on her husband nahim the man jazz her toto.  Aproko Report ask one Babalawo wai dey based for Lagos about this type of jazz. He say he no want make we post him name and that him never see this type of juju but Kenya obviously get am. He say to revere this kind of juju go cost the boy wella but hope still dey. He advice the boy to beg the husband and may be find better church make them pray for him life as him problem f it bad pass him prick changing positio n . This other guy wan laugh. Idiot!  The Babalawo con say, em fit be say the boy get curse and na so dem born am. He say when next he travel through astral-projection to Kenya, he must track down the Witch-Doctor wai make this type of juju and learn. We go bring you upd...

Senate Wan Make Buhari Conduct Census By 2018

The Senate for Nigeria don ask president Buhari make him start to dey prepare for de counting of everybody wai dey for Nigeria. This counting na de census. This na something wen former president Obasenjo been last do (that year, 2006). So this idea come from the motion wen one Senator Sule Hunkuyi forward for plenary today ‎for Abuja. As usual, them say make government think about am and release money quick quick for de project to succeed. Hunkuyi use better word take wash the matter say na part of planning o. As usual, they ask for money for the NPOPC (National Population Commision) because better thing na money kill am and as year don dey end, ei go better for government to join am inside 2017 Budget. He say ei don tai since the last census and by the time 2018 for don reach, ei go be 12 years space between de two census. He say, based on international standard, ei suppose take 2 year to plan proper census. Another senator, ‎John Enoh say the plan make sen...

BREAKING NEWS: Kidnapped Student and Principal Freed

Igbonla Senior and Junior Model Collage. You know that time when we tell you about how gunmen bustenter one secondary school kidnap 2 student, head teacher and principal? One aproko for Lagos State Ministry of Information don reveal to us say, the victims don rescue. he no make am clear wader dem pay ransom, all he say na dey don regain dir freedom and go re-unit with their family. Ei no easy o, person just go school/work and end up prisonal for 5 days. Anyway, Lagos State Deputy Governor, Dr. Idiat Oluranti Adebule go address press. We been dey fear say the kidnapper go release video where dem go announce say dey don marry the 2 student and principal. I just dey happy say dem no allow this one turn to #BringBackOurGirls campaign. I sure say this student go fit speak english sha. Congratulation to the police for not allowing the matter turn to something else as all the victim dey safe.